Family and friends Gathered From All over The World for Herbert Wigwe, wife and son funeral service

Family and friends Gathered From All over The World for Herbert Wigwe, wife and son funeral service

Di combined funeral service for di late Chief Executive Officer of Access Holdings, Herbert Wigwe, im wife Chizoba and son Chizi dey go on for RCCG Tribe of Judah Parish for Isiokpo, Ikwerre local goment area of Rivers State.

On Friday 8 March, Govnor of Rivers State, Sir Siminalayi Fubara along with govnors of Lagos and Ogun State, Babajide Sanwolu, Chief Dapo Abiodun, Minister of Trade, Chief Wale Edun, FCT Minister, Chief Nyesom Wike, Mr. Peter Obi, former govnors of Ekiti and Delta, Kayode Fayemi and Chief James Ibori.

Ogbonge businessman Aliko Dangote dey among distinguished Nigerians wey attend di Christian wake-keeping and commendation service for late Herbert Wigwe, im wife Chizoba and son, Chizi for Isiokpo.

Herbert Wigwe burial

WIA DIS FOTO COME FROM,RVGH PRESS

Herbert Wigwe burial

WIA DIS FOTO COME FROM,RVGH PRESS

Wetin we call dis foto,Children of late Herbert Wigwe: R-L -Tochi, David and Hannah Wigwe

Herbert Wigwe burial

WIA DIS FOTO COME FROM,RVGH PRESS

“Make your life make impact” – Govnor Fubara

Herbert Wigwe burial

WIA DIS FOTO COME FROM,RVGH PRESS

For di funeral service, Govnor Siminialayi Fubara of Rivers State tell pipo say make dem ensure say dia life make impact.

Govnor Fubara tok say late Wigwe don finish di work e come do for di world and add say wetin remain na for pipo to do dia own.

E assure say di state goment go try to work wit di Wigwe Foundation to immortalise di legacy of di bank chief and ensure im dream for di Wigwe University come true.

Dignitaries wey attend di funeral service include Senate President Godswill Akpabio, govnors of Bayelsa and Akwa Ibom States Sen. Douye Diri and Pastor Eno Umo, former CBN govnor Emir Sanusi Lamido Sanusi, Aliko Dangote, Peter Obi, Aminu Tambuwal among many odas.

On im part, Senate President Godswill Akpabio wey represent President Bola Tinubu say di death of Wigwe no be only big loss to di business community but na also great loss to Nigeria as kontri and e go continue to mourn am even afta di burial.

E extend di condolences of di federal goment to Wigwe papa and mama as well as di immediate family and encourage dem to keep up di good legacy of dia son and father.

Herbert Wigwe burial

WIA DIS FOTO COME FROM,RVGH PRESS

Wigwe Burial

WIA DIS FOTO COME FROM,RVGH PRESS

Herbert Wigwe burial

 

Govnors of Rivers, Lagos and Ogun States for di commendation service

Commendation service

WIA DIS FOTO COME FROM,RVGH PRESS

Wetin we call dis foto,Captains of Industry also attend di commendation service

Pipo for di service

WIA DIS FOTO COME FROM,RVGH PRESS

Wetin we call dis foto,Di commendation service hold on Friday 9 March for Isiokpo

Herbert Wigwe burial

WIA DIS FOTO COME FROM,RVGH PRESS

Wetin we call dis foto,Na di Redeemed Christian Church of God RCCG conduct di service

Na di Redeemed Christian Church of God conduct di commendation service wey gada many political stalwarts, captains of industry and sympathisers from across di kontri.

Pastor in charge of Region 33, South-South, Pastor David Adeoye, advise pipo to do good to humanity with whatever position dem occupy and add say di commendation service for Herbert Wigwe na opportunity for dem to reflect on di lifetime legacies di late bank chief leave behind, not just for di industry but to all shades of humanity.

Herbert Wigwe burial

WIA DIS FOTO COME FROM,RVGH PRESS

Commendation service

 

 

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*